By: Yusuf Abuh
Senator representing Osun East, Francis Fadahunsi, don clear im name after one viral video wey suggest say e tell im supporters to kpai Accord Party members and dia families, say nor be wetin im mean dem edit.
Fadahunsi tok dis one on Wednesday after police question am for Osun State Police Command headquarters for Osogbo over di controversial video.
Di senator explain say when e use di word “kill”, e mean say im supporters should use dia votes to “kill” Accord Party for di August 15 governorship election, nor be real life killing.