Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Written by: Kofoworola Olayinka
Make we talk truth oooo, when celebrity love break, everybody go hear am.
Celebrity breakup no dey ever dey quiet, once social media catch am like dis, di whole internet go turn microphone.
For Naija entertainment, we don see plenty celebrity marriages wey start with love, glamour and beautiful pictures, but later end with breakfast and public drama.
Make we give enter di mata wey sup between Frank Edoho and him second wife, Sandra Onyenucheya.
Wetin Really Sup?
Di relationship between popular television host and media personality, Frank Edoho and Sandra Onyenucheya, scatter scatter for ground for 2026, after di two both of dem share update unto wetin really play inside dia love life, but according to online gist, wey dey fly up and down, Sandra and Frank give different tori on top di mata and like dis, we no even know who cause di gbege.
Sandra Tori:Â
For Sandra side, she allege tuk say while she and Frank sti dey married, he dey run things with other women, and she even claim say one of di affairs happen when she dey carry belle. She also allege say Frank pressure am to abort dia second pikin, and dis one cause serious pain and hurt for di marriage.
Sandra still fry mouth put say she suffer both emotional and physical abuse, and sometimes ehnn, Frank go disappear from house for days, abandon am to face things alone. According to her, di mata reach one point wey she realise say she must choose herself and comot from di marriage to save her peace and herself.
Frank Tori:
Meanwhile, Frank for one fry mouth put on top di tori wey sandra tuk, say na lie, say im get di original story on top di doings,
Frank allege say as Chike enter di picture like dis, dat one become di final nail for di coffin of dia marriage.
He claim say he discover evidence say Sandra and Chike dey run one or two together , but sake of say dem get children together, he first try hold di marriage together.
Frank say e even confront Chike face-to-face, warn am say make he leave Sandra alone, but according to am, di alleged relationship still continue, but Sandra deny say she no cheat on Frank, say her connection with Chike start as business, say she meet am professionally for 2024 and dem only become friends for 2025.
According to Sandra, she insist say Chike no scatter her marriage, according to her, by di time Chike enter her life, di marriage with Frank don already dey scatter scatter for ground.
While according to Frank, he claim say di mata don reach boiling point one time like that and he pack comot from di marriage for about three months, before Sandra later beg am to come back.
Conclusion:
Based on wetin different reports talk, Frank and Sandra never agree on one particular reason why dia marriage scatter scatter.
But Frank later talk say di downfall of him second marriage throw am inside one dark place wey start around December 2022, and for dis period, di pain of di failed marriage really hit am hard. and by 2026, Frank say him and Sandra don dey live separate lives for about two years, and di mata don enter divorce process as both of dem begin move on from di marriage.
Read more interesting tori for here:https://konfamfm.com/must-read-di-truth-about-marriage-wey-most-pipo-no-understand/
Written by: Rilwan Agbomeji
CELEBRITY Frank Edoho marriage
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Â
Copyright KONFAM 2026
This will close in 0 seconds