Lagos

EFCC Gbab Two Men Over Bank Access Details

todayAugust 20, 2026 4

Background
share close

EFCC on Wednesday, August 19, arrest Gideon Aghogho and Oscar Chukwuebuka for Federal High Court, Ikoyi, Lagos, over alleged illegal supply of bank access details.

EFCC accuse dem and one suspect wey dey run, Scott, say dem supply details wey fit give access to one bank database between July 24 and 26, 2026.

Aghogho plead not guilty, while Chukwuebuka plead guilty as court order say dem remain for correctional centre pending further proceedings.

Justice F.N. Ogazi adjourn di case till August 27, 2026, for review of facts and continuation of di matter.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds