EFCC

24 Results / Page 1 of 3

Background

crime& security

EFCC Recover N1.23trn, $684m And Plenty Other Money

By: Kofoworola Olayinka EFCC Chairman, Ola Olukoyede, don tok say di commission don recover N1.23 trillion, $684 million, £373,905 and €9.34 million between October 2023 and June 2026. Olukoyede yarn dis on Monday while e dey address media executives and journalists for Abuja. E say di money and properties wey dem recover na from financial crimes, with plenty of di naira recoveries wey dem make on behalf of gornment ministries. […]

todayAugust 31, 2026 8

National

EFCC Go Pay Whistleblowers Up to 5% for Recovered Loot

By: Kofoworola Olayinka EFCC Chairman, Ola Olukoyede, don offer whistleblowers between 2.5 and 5 per cent of recovered stolen Nigerian assets for useful information on assets wey dey abroad. Olukoyede make di announcement on Wednesday while speaking for Cambridge International Symposium on Economic Crime for di United Kingdom. He say EFCC ability to trace assets, judicial cooperation and access to credible intelligence dey help di commission recover stolen wealth through […]

todayAugust 26, 2026 14

crime

EFCC Don Withdraw Cybercrime Case Against BUK Student

By: Kofoworola Olayinka Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don withdraw di cybercrime charge against final-year Bayero University student, Maryam Shehu, and another Nigerian, Abubakar Abdulhamad. Di two of dem face separate case for Federal High Court for Abuja on Thursday over alleged cybercrime and spreading bad information about EFCC. EFCC accuse Maryam of making social media post wey allege say some EFCC pipu beat one man and collect N20 […]

todayAugust 21, 2026 16

Lagos

EFCC Gbab Two Men Over Bank Access Details

EFCC on Wednesday, August 19, arrest Gideon Aghogho and Oscar Chukwuebuka for Federal High Court, Ikoyi, Lagos, over alleged illegal supply of bank access details. EFCC accuse dem and one suspect wey dey run, Scott, say dem supply details wey fit give access to one bank database between July 24 and 26, 2026. Aghogho plead not guilty, while Chukwuebuka plead guilty as court order say dem remain for correctional centre […]

todayAugust 20, 2026 12

OBODO NAIJA

Tinubu Order Recovered EFCC Money Make E Go NELFUND

Presido, Bola Tinubu on Wednesday order say all liquid funds wey EFCC recover, plus unclaimed dividends, make dem divert go NELFUND to strengthen di student loan scheme. Minister for education, Tunji Alausa naim disclose dis after Federal Executive Council meeting for Presidential Villa, Abuja, on Wednesday. Alausa say Tinubu give di order to make sure NELFUND get enough money to continue funding students for long term. Di council meeting na […]

todayAugust 20, 2026 10

OBODO NAIJA

Election Materials Finally Drop For Osun State

Sensitive election materials don reach Osogbo ahead of Saturday’s Osun State gornorship election, as INEC talk say e go pick ad-hoc workers from more than 30,000 NYSC members. Security agencies don also increase preparations for di election, as no fewer than 25,310 personnel from Nigeria Police Force, Civil Defence and EFCC don deploy across di state. INEC Chairmo Chief Press Secretary, Adedayo Oketola, tok dis on Monday while giving update […]

todayAugust 11, 2026 13

Politics

Tinubu Order EFCC Make Dem Unfreeze Osun Gornment Account

By: Esther Daniel Oga presido Bola Tinubu on Thursday direct EFCC make dem immediately return to court and cancel di order wey freeze Osun State Gornment account, after di action cause public criticism ahead of di August 15 gofnorship election. Tinubu, through im spokesman Bayo Onanuga, say although EFCC get power to do investigations, di timing of di account freeze embarrass am because people fit see am as political interference. […]

todayAugust 6, 2026 16

OBODO NAIJA

NBA Fire EFCC, Say Dem No Get Power Freeze Osun Account

By: Jolayemi Olajide Nigerian Bar Association, NBA, don tell EFCC say dem no get legal power to just freeze Osun State Government allocation account without first follow court and constitutional process. EFCC bin write First Bank on Wednesday make dem block every withdrawal from di account as dem dey investigate alleged N11 billion fraud wey involve Ecology Fund, Intervention Fund and FAAC money. Di letter wey Assistant Commander Adenike Babalola […]

todayAugust 6, 2026 12

south west

Atiku Blast EFCC, Say Dem Dey Chook Hand for Osun Election

By: Yusuf Abuh Presidential candidate of African Democratic Congress, Atiku Abubakar, don accuse EFCC say dem dey attack democracy after dem freeze Osun State Gornment statutory allocation account few days before Saturday gofnorship election. Atiku tok dis one on Thursday for Abuja through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, say di timing of di action no pure at all. According to am, no reason […]

todayAugust 6, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds