Politics

Tinubu Knock Atiku Over Plan To Bring Back Fuel Subsidy

todayAugust 21, 2026 5

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

Presido Bola Tinubu don criticise former Vice Presido, Atiku Abubakar over im plan to bring back fuel subsidy if e win di 2027 presidential election.

Tinubu talk dis one on Thursday for State House, Abuja, saying Atiku plan show say e no understand gofnance and economy well.

Di President say before fuel subsidy comot, 27 states no fit pay worker salary and gofrnors dey come Abuja dey ask for bailout.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds