By: Mariam Ajayi
Pope Leo XIV don call on di international community make dem join hands help Democratic Republic of Congo fight Ebola disease.
Di Pope make dis call on Sunday after im Angelus prayer for St Peter’s Square, as e urge local communities to also join di effort to save lives.
He say di suffering wey Ebola don cause for Congo serious, and e don worry am say instead of blessings to spread, na disease dey spread.
Pope Leo XIV therefore appeal to world leaders and organisations to find urgent way to support Congo for di fight against Ebola.