By:Mariam Ajayi
Accordingt by di Deputy Foreign Minister, Kazem Gharibabadi say US must first return to im commitments before dem fully open di waterway.
U sabi say, US President Donald Trump say all mines (dat navy bomb) for di international waters of di strait don clear and warn say any ship wey try plant new bomb ehn go dance osurugede dance, dem never shishonshi.
Meanwhile, US State Department say Washington dey take Ogbongelicous  steps to cut off Iran remaining money channels and follow up with more sanctions.
For Gaza, Israeli attacks don continue despite di ceasefire, with at least seven Palestinians reportedly killed on Tuesday, including three people wey die after strike hit residential building for Beit Lahiya.