strait of hormuz

40 Results / Page 1 of 5

Background

obodo oyinbo

Trump Promise No Attack For Iran Again Until November 3rd

By: Mariam Ajayi Iran military force don konfamate say dem dey do operation every night inside Strait of Hormuz to catch any ship wey break dia law. Mean wider, President Donald Trump say US for dia on part sef dey tuk with Iran and promise say, dem nor go attack dem before di November 3 midterm election. Already Dis tension don make oil price jump up by four percent, carry […]

todayOctober 9, 2026 8

obodo oyinbo

Iran Say Make Ceasefire Happen Before Hormuz Open

By: Kofoworola Olayinka Iran Foreign Minister Abbas Araghchi say Qatar dey hope say dem go reach agreement by tomorrow to reopen di Strait of Hormuz. Araghchi say Iran don give conditions for reopening di waterway, including seven-day ceasefire across di Middle East. Di Strait of Hormuz dey carry about one-fifth of global oil and liquefied natural gas, making di blockade a major concern for global energy supply. Iran impose di […]

todaySeptember 29, 2026 7

obodo oyinbo

Iran Meet Qatar For US Peace Toks

By: Mariam Ajayi Senior man, Iran Foreign Minister, Abbas Araghchi, don run go meet Qatari tok tok pipo for New York to see how dem go take bring peace for di Strait of Hormuz. According by wetin Araghchi tok on monday, say na di Qatari guys go carry di peace tok t go meet America When pipo ask am say whether e go wait for New York to hear di […]

todaySeptember 29, 2026 10

obodo oyinbo

Iran Army Boys Strike Oil Tanker For Strait Of Hormuz

Iran Revolutionary Guard boys announce on Friday say dem shoot one oil tanker inside Strait of Hormuz after di ship try pass without paying dem money. British maritime agency konfamate say explosive hit di vessel on Friday before di crew quench di fire. Di military boys declare say dem attack di ship because e try illegal passage through di route.   Read more tori for here:https://konfamfm.com/iran-guards-say-dem-attack-oil-tanker-for-strait-of-hormuz/

todaySeptember 18, 2026 15

obodo oyinbo

Iran Guards Say Dem Attack Oil Tanker for Strait of Hormuz

By: Kofoworola Olayinka Iran Revolutionary Guards don tok say dem strike one oil tanker for Strait of Hormuz on Friday, according to Iranian state news agency IRNA. One British maritime agency too report say attack happun. Iran still dey control movement for the strategic Strait of Hormuz as United States continue to put pressure on Iranian ports during the ongoing Middle East war. The Islamic Republic say e want make […]

todaySeptember 18, 2026 13 3

obodo oyinbo

Trump Boil Hot, Vow To Turn Iran Back To Factory Setting

By: Mariam Ajayi US Presido, Donald Trump don enter high gear dey brag say e mind dey tell am to totally wipe out e Iran enemies, warning say anything fit happen as e head dey boil like hot stew. Wetin hapun be say,  aproko dey fly dat some Iran army boys go  scarra one big cargo ship for Strait of Hormuz water, while UN investigative panel come open tuk, say […]

todaySeptember 18, 2026 11

obodo oyinbo

Qatar Cry Out Say Iran And US Dey Spoil Business For Dem

By: Yusuf Abuh Oya oh, Middle East dey boil like dis, pepper bodi everywia as  Qatar Foreign Ministry spokesperson, Majed Al-Ansari, dey cry give US make dem calm down for di Strait of Hormuz, say oil business dey suffer. According by di oyinbo wey dem speak news statement, “industrial catastrophe naim dey hapun for di strait of Hormuz. Kpler data show say na only about 10 cargo ships dey manage […]

todaySeptember 8, 2026 12

obodo oyinbo

Trump Want Make Dem Change Strait Of Hormuz Name

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don suggest make dem change di name of Strait of Hormuz to “Trump Strait.” Trump make di suggestion for im Truth Social page, saying America now dey control di waterway. He ask whether dem suppose rename di Strait of Hormuz after am, calling di proposed name “Trump Strait.” Trump even joke say, just like America, di new name go make di place “hotter” […]

todaySeptember 2, 2026 21

obodo oyinbo

Irab Write Conditions Like NEPA Bill To Open Strait Of Hormuz

By: Mariam Ajayi Iran security chief, Mohsen Rezaei, don tuk say Tehran dey prepare long list of conditions before dem go open Strait of Hormuz. Qatar Prime Minister don travel go Tehran go beg Iran make dem calm down, but Iran no gree. Meanwider, US gorment pipo say Iran action na just initial gragra as American naval blockade still tight. Di mata don turn serious gbas-gbos between Iran and America, […]

todayAugust 28, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds