By: Ayobami Dada
Lagos Police don deny report say dem fire tear gas on pensioners during dia protest for Alausa on Monday, August 31.
Police say about 500 pensioners gather peacefully, while security operatives dey maintain order, dem no fire any tear gas.
Di Command say after government officials address di protesters, NUP executives hold meeting before dem peacefully comot around 4:30pm.
Police also yarn say di viral photo wey show say pensioners receive tear gas na AI-generated image, and dem warn people to stop dey share unverified information.