National

Akpabio Carry Alleged Anti-North Statement Go Giv Department of State Service

todaySeptember 10, 2026 2

Background
share close

By: Ayobami Dada

Senate Presido,  Godswill Akpabio don petition Department of State Services, DSS, on top one statement wey dem dey circulate for Facebook and other social media platforms, wey allegedly dey attack pipu from Northern Nigeria.

Na di Special Assistant on Media to di senate presido, Jackson Udom, carry di petition for hand giv tori pipu for Abuja on Wednesday.

Akpabio Chief of Staff, Chinedu Akubueze, file di petition on behalf of di Senate Presido, ask DSS to say make dem touchlight di statement wey some pipu wrongly attribute to Akpabio.

Di statement, carry Akpabio picture and official position, allegedly quote am tok say: “Northerners, una go suffer pass if una allow Tinubu lose di election.”

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds