Godswill Akpabio

10 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Akpabio Open National Assembly Door For Four New Senators

By: Emmanuel Ariyo-David Senate Presido Godswill Akpabio on Wednesday swear in four new senators wey win di recent bye-elections wey INEC conduct. Di lawmakers na Olaka Nwogu of PDP for Rivers South-East, Envulu Anza of APC for Nasarawa North, Ikeje Asogwu of APC for Enugu North and Dayo Faduyile of APC for Ondo South. Dem enter Senate after last Saturday bye-elections wey happen to fill vacant seats for di four […]

todayJune 24, 2026 6

OBODO NAIJA

President Tinubu drop Promise Say Beta Life

Wi oga Presido Bola Tinubu don drop bombshell say im nor promise Nigerians any miracle oh but beta gornment policies and development projects. Baba Seyi dey yarn dis on through Senate Presido Godswill Akpabio during di commissioning of one new access road and bridge for Abuja on Thursday. Im nor understand why pipo dey drag gorment and dat im administration  focus na to build ogbonge projects wey go improve di […]

todayJune 19, 2026 13

OBODO NAIJA

Akpabio Clear Nigerians Why Everybody Need To Fire Prayer

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin, wi Senate Presido, Godswill Akpabio don tell Nigerians on Sunday, say wi need to fire payers oh, unto di way, wey pipo take dey lose for di country. Akpabio drop dis one for im abuja office, say, like im don start monthly prayer session to block kidnapping and killing, an im run same thin when im be Governor for Akwa Ibom State. […]

todayJune 8, 2026 12 4

National

Oshiomhole Tell Akpabio To Resign As Senate Presido

By: Esther Ayoola Oga Seneta wey dey represent Edo North for Senate, Adams Oshiomhole don call on Senate Presido, Godswill Akpabio, say make e resign over di new amendment for Senate Standing Orders. Oshiomhole tok dis one for Abuja afta Thursday Plenary, say di new rules get “moral crisis”, dat person must do 8 years for senate before e go fit become senate presido, nor make brain and dat Even […]

todayMay 8, 2026 12

OBODO NAIJA

Akpabio Promise Beta Life for Naija Workers

Senate Presido, Godswill Akpabio don scatt im mouth untop matas, say National Assembly dey aware of di hardship wey Nigerian workers dey face. According to di message wey di senate presido send to mark 2026 Workers’ Day, say di national assemble go continue to work on laws wey go improve workers’ welfare. Di naija number three man, Akpabio assure nigerians say di 10th National Assembly go try dia best to […]

todayMay 1, 2026 15

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Hold Talk on Beta National Mata With Senate Oga Dem

Presido Bola Tinubu on Wednesday meet Senate ogas for closed-door meeting inside Presidential Villa, Abuja. According to reports, dem take serious decisions on key national issues during di high-level meeting, as dem discuss urgent matters wey concern di country. Senate Presido Godswill Akpabio na im lead di Senate team wey include Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, Senate Leader Opeyemi Bamidele, and Minority Leader Abba Moro.

todayApril 23, 2026 15

OBODO NAIJA

Senate Approve Tinubu $6bn Loan To Fix Ports, Cover Budget Gap

Senate don approve oga Presido Bola Tinubu request to borrow $6 billion from outside. Chairmo of di Senate Committee on Local and Foreign Debts, Senator Aliyu Wamakko, clear dis mata say, Tinubu write two separate letters to Senate Presido, Godswill Akpabio, asking $5 billion from Abu Dhabi Bank for budget deficit and old debts, and $1 billion from UK Export Finance through Citibank London to fix Lagos and Tin Can […]

todayApril 1, 2026 15

National

Akpabio Explain Say Senate No Stop Electronic Election Result Transmission

By: Esther Ayoola Senate President Godswill Akpabio, say Senate no remove electronic transmission of election results for di amendment wey dem dey work on. E tuk say lawmakers just wan discuss if e suppose dey mandatory make results dey show for real-time. Akpabio defend di amendment, say, badbelle pipo just  dey rush judgement based on part of di legislative work.

todayFebruary 9, 2026 13

Local

Akpabio Don Tell Nigerians: Make Una Protect Government Facilities Wey Dey Una Area

President of Senate, Godswill Akpabio, don beg Nigerians make dem protect government facilities wey dey their communities. E give dis advice on Tuesday as e dey commission some projects for Ika Local Government Area for Akwa Ibom State. “My duty as your representative for Senate na to make sure say I bring the projects wey una ask for, for the betterment of everybody,” na wetin Akpabio talk inside one statement […]

todayAugust 28, 2025 43

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds