By: Ayobami Dada
Pipu wey dey travel by air for UK face more wahala on Wednesday as dem cancel nearly 400 flights across di country, after technical problem affect Britain air traffic control service, wey say di incident no be cyberattack.
After 1,746 flights cancel on Tuesday following di outage, another 399 flights cancel on Wednesday, mostly flights wey dey go or come from London Heathrow Airport, one of Europe busiest airports.
Airlines UK say more than 330,000 passengers feel di effect of di two-day disruption, with about 155,000 flights cancelled and around 180,000 passengers experiencing delays.
One passenger, Ernster, say as dem finally allow dem comot from di plane, everywhere don scatter and confusion full ground, while people struggle to collect dia bags with no hotel anywhere near for up to two hours journey.