By: Mariam Ajayi
Naija Falconets don manage 0-0 draw with China for Arena Sosnowiec inside Poland, as dem bag first point for Group F after losing dia first game two-zero to Spain.
Even though di Nigerian gals create fine-fine scoring chances, e con be like say, China na AI robot dem take block dia post.
With dis game, China dey four points while Spain don already secure ticket to Round of 16 with six full points.