Lagos

Lagos Assembly Mourns Former Member Kamal Olorunoje

todaySeptember 16, 2026 3

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Di Lagos State House of Assembly don mourn former member, Honorable Kamal Owolabi Olorunoje, wey kpai on Tuesday morning.

Na Honorable Lanre Afinni, wey dey represent Lagos Island Constituency 2, announce di death for Plenary on Tuesday, tok say Olorunoje represent di same constituency for di 3rd Assembly before e later serve for Lagos State Civil Service Commission.

Di House kon stand up to observe one minute silence for di late lawmaker, and Speaker Mudashiru Obasa also use dis opportunate take mourn Nollywood actor, Alhaji Taiwo Hassan, wey pipo sabi as Ogogo, wey kpai some weeks ago, as di actor make better contribute to Nigerian entertainment industry.

Speaker Obasa kon direct di Clerk say make she send di Assembly condolences to both families and dem pray make Almighty God give dia families di strength to bear di loss.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds