Nigeria Labour Congress (NLC), don call on Federal Gornment to quickly bring measures wey go reduce di suffering wey rising petrol price dey cause.
NLC Presido, Joe Ajaero, tok for statement on Wednesday say petrol don reach about ₦1,430 per litre for major cities, while di price fit dey higher for places wey hard to reach.
Labour warn say di petrol price increase go make economic hardship worse, as transport fare dey affect di price of food, house rent, school fees and other important things.
NLC sti add say gornment suppose pay workers reasonable wage award and allow local refineries buy crude oil from Nigeria in naira.