obodo oyinbo

European Union Wan Ban Under-13 Pikin From Social Media

todaySeptember 17, 2026 4

Background
share close

By: Ayobami Dada

European Union don bring plan wey go stop pikin wey never reach 13 years from using social media,as di EU dey try protect children from things wey dey make dem spend too much time online.

EU chief, Ursula von der Leyen, announce di plan on Wednesday for European Parliament, say under di new plan, pikin go only fit use social media with limited and supervised access until dem reach 15 years.

Australia na di first country to put full ban on social media for children under 16 since end of 2025, while California for America don also tighten rules on how children dey use social media

More than 20 countries around di world don already take steps to restrict how children dey enter social media. Seven countries don already start their own rules or dey prepare to start am.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds