By: Ayobami Dada
Wi Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don add some days to him working vacation, and e dey expected to return back to Nigeria dis weekend.
For inside statement wey di presidency release on Monday, Presidential Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tok say Tinubu still dey follow wetin dey happen for Nigeria and dey continue to direct di affairs of di country even as e dey abroad.
Since Tinubu comot go London on di 30th of August, na di Vice Presido, Kashim Shettima dey represent am for some official functions.
But Shettima comot Abuja on September 20 go New York to attend di 81st United Nations General Assembly, wey di general debate go start on Tuesday, September 22.