Federal Gornment don give di 10-pipu committee full hand to touchlight how 37 pipu wey Nigerian Security and Civil Defence Corps gbab for Niger State take kpai on Thursday, September 17.
Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, tok dis one for Abuja on Tuesday, September 22, saying di committee fit bring experts, check documents and facilities, visit places connected to di matter.
E say di committee fit also ask members of di public for information, and interview anybody wey fit help dem understand wetin happen.
Tunji-Ojo also direct NSCDC leadership and other officers make dem cooperate gidigba with di committee, while dem must keep all records and evidence wey dey connected to di incident.