OBODO NAIJA

Naija Beg World Make Dem Give Violence Victims More Help

todaySeptember 25, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Naija don beg countries around di world make dem no stop to dey helep pipo wey terrorist attacks don affect.

Defence Minister, General Christopher Musa, make di call for di United Nations General Assembly, UNGA meeting for New York.

Musa say Africa don suffer plenty from terrorism, with sub-Saharan Africa recording about 60 per cent of all deaths from terrorism around di world for 2025.

E say terrorist attacks don make many families lose dia homes, money and loved ones, so di victims need steady support to helep dem start dia lives again.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds