By: Mariam Ajayi
Sudan army chief, Abdel Fattah al-Burhan, don swear say hin no go gree, da thin nor dey tok with RSF, di ogbonge paramilitary group wey dey disturb sudan, say na force hin go take comot dem from sudan.
Al-Burhan drop dis yans on Tuesday for Merowe, say, since di RSF pipo nor wan hear word, na pure war, Idaboski doings, be di only option to finish paramilitary group.
Dis strong warning come as di bloody fight wey start for April 2023 don already send tens of thousands people go meet dia maker and chase about 13 million komot house.
To show say fire dey burn everywhere, local charity group confam say RSF drone attack just wipe out 10 innocent civilians for West Kordofan state.