Sports

Jay-Jay Okocha Back Mbappe For 2026 Ballon d’Or

todayOctober 13, 2026 9

Background
share close

Super Eagles legend Jay-Jay Okocha don back Real Madrid star Kylian Mbappe to win di 2026 Ballon d’Or award.

Di former PSG playmaker tok dis one during interview with French paper Le Journal du Dimanche, wia fry mouth  say Mbappe goal-scoring record make am stand out pass order top players like Harry Kane and Lamine Yamal.

Okocha explain say Mbappe deserve di big prize because e finish as top scorer for World Cup with 10 goals, Champions League with 15 goals, and Spanish La Liga with 25 goals.

Apart from di individual award, di Nigerian football icon also pick Manchester City, Barcelona, and Bayern Munich as di main teams to fight for di Champions League trophy dis season.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds