obodo oyinbo

Ukraine Russia War No Concern Zelensky – Trump Tok

todayOctober 19, 2026 6

Background
share close

US Secretary of State, Marco Rubio, on Monday deny say America don suspend intelligence sharing with Ukraine, as e tell Presido Volodymyr Zelensky say make e focus on how to end di war with Russia.

Rubio tell tori pipu say no pause dey at all, and when dem ask am about Ukraine, he claim say America stop to dey send intelligence wey go hellep dem fight against Russia missile attacks.

Zelensky don tell US media on Sunday say America don remove di blockage after dem stop di intelligence sharing for three days.

According to Rubio, US Presido Donald Trump want make Zelensky and Russian Presido Vladimir Putin to focus on end di war wey don enter five years like dis.

Trump write for im Truth Social platform on Sunday say e dey try wella wella to bring peace between Russia and Ukraine, but e accuse Zelensky say e no get interest to end di war, despite di plenty money wey Europe dey give am.

Trump also accuse Zelensky say e dey target diesel refineries for Russia, knowing say di attacks dey seriously affect diesel market around di world, including America.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds