Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don mourn former Delta State Govo, Dr Emmanuel Eweta Uduaghan, wey kpai, as e describe am as elder brother wey dem get good working relationship.
Obi tok say e dey deeply sad over di death of di former Govo, as e remember how Uduaghan treat am like im younger brother anytime wey dem meet.
E also remember how dem work together when dem dey public service, especially dia joint effort to push for di contract award of Second Niger Bridge project.
Obi say di relationship wey dem share and di work wey dem do together na memories wey go remain with am.