Nigeria Labour Congress (NLC) don cry out say worker dey sufferly dey dey, heavy Sapa and bad economy, even with N70,000 new minimum wage.
NLC President, Joe Ajaero, fry dis tok for Abuja as e drag gornment say nor be wetin dem agree naim dey hapun, price of petrol dey rise like high blood pressure.
E insist say de two-week deadline wey dem give Federal Gornment to cut petrol price and start fresh salary tok still remain oh, if not workers go enter strike nation wide.
Ajaero come beg gorment make dem quickly step to clear dis hardship, instead of to wait until strike or protest hapun.