Federal Gornment on Wednesday don praise di Presidential Task Force on Ebola Preparedness over how dem quickly detect Nigeria first Ebola case, as dem assure Nigerians say dem fit control di disease.
Chairman of di task force and Chief of Staff to Presido, Femi Gbajabiamila, tok dis one after emergency meeting for State House, Abuja, according to statement wey Special Adviser to Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, sign.
Gbajabiamila tok say di task force, NCDC and other agencies dey on top di matter, and dat di gornment and di pipu must collabo to contain di disease, e also tell Nigerians say make dem follow all gornment directives for dia own good.