Diplomatic meeting don dey happun across Middle East as different countries dey try find way to end di war between United States, Israel and Iran.
Pakistan Army Chief, Asim Munir, reach Tehran on Wednesday to discuss di war matter and di latest tension for Yemen, as fear dey grow say fresh fight fit burst but Iran still stand gidigba for im position, say di war no go end and Strait of Hormuz no go reopen until United States agree to im conditions.
Iran still hold strong ground on top dia nuclear programme, wey contribute to di reason US Presido Donald Trump decide to launch di war on February 28, as Trump don tok plenty times say e want scatter Iran nuclear programme.