IRAN

63 Results / Page 1 of 7

Background

obodo oyinbo

US Vice Presido JD Vance Dodge Update on Iran War

By: Mariam Ajayi US Vice President JD Vance like dis now dey dodge questions on updates of how di war between America, Israel, and Iran go end. Tatafo pipo bin block Vance, e  try to cool di matter down for White House press briefing on Thursday, con even ague say nor be war dem dey fight for Iran. Although heavy bomb-blast don dey fly between US and Iran for days, […]

todaySeptember 4, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Says US and Iran Fight No Go Last Long

By: Mariam Ajayi Trump say US-Iran fight no go last too long, but US fit strike Iran anytime. Trump say America ready to attack Iran anytime, as Tehran vow to unleash new war strategy. Meanwider,Iran Health Ministry say US attacks don kill 18 pipu, including two women and one child. Kermanpour say 142 pipu don sustain injuries from di ongoing US attacks on Iran, including 61 women and 44 minors.

todaySeptember 3, 2026 15

obodo oyinbo

Trump Drag Iran as War Vibe Rise High for Middle East

By: Mariam Ajayi US Presido Donald Trump don vex enter street, say e go reset Iran boys software  after dem fire missile attack US pipu for Jordan. Iran Guards brag say dem don shoot down American MQ-9 drone over Strait of Hormuz. Trump don warn Iran say even after dem don hammer dia money and military, dem fit still land one hot slap if Iran try test dem patience. As […]

todaySeptember 1, 2026 8

obodo oyinbo

Irab Write Conditions Like NEPA Bill To Open Strait Of Hormuz

By: Mariam Ajayi Iran security chief, Mohsen Rezaei, don tuk say Tehran dey prepare long list of conditions before dem go open Strait of Hormuz. Qatar Prime Minister don travel go Tehran go beg Iran make dem calm down, but Iran no gree. Meanwider, US gorment pipo say Iran action na just initial gragra as American naval blockade still tight. Di mata don turn serious gbas-gbos between Iran and America, […]

todayAugust 28, 2026 8

obodo oyinbo

Iran Knack Chest Say Dem Ready To Face Fresh US Sanctions

Iran don talk say e ready to withstand di wider sanctions wey United States announce to isolate di country from di global economy. Iranian Economy Minister Ali Madanizadeh say Tehran fully prepared for di measures and believe say dem go lead to another defeat for America. US Treasury Secretary Scott Bessent say any country, bank or business wey continue financial dealings with Iran go face isolation if dem refuse to […]

todayAugust 25, 2026 10 3

obodo oyinbo

Netanyahu Swear Say Iran No Go Control Any Palestinian State

By:  Mariam Ajayi Israeli Prime Minister, Benjamin Netanyahu don swear say as long as e remain Prime Minister, e no go allow any Palestinian state wey Iran dey control to happun. Netanyahu make di statement for weekend, August 23, 2026, for message wey e post on X, as argument over Palestinian statehood continue to dey hot. E say Gaza and Judea and Samaria, wey Israel dey use refer to di […]

todayAugust 24, 2026 9

National

Iran Set Conditions For Opening Strait Of Hormuz, Demands US Action

By: Kofoworola Olayinka Iran top negotiator Mohammad Bagher Ghalibaf don say di country no go open di strategic Strait of Hormuz until United States meet dia demands. Ghalibaf talk on Tuesday say America must remove di naval blockade, lift oil sanctions and unfreeze Iran money wey dey abroad before di strait fit reopen. E say di demands dey inside di Iran-US truce wey dem a

todayAugust 19, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Drag Trump Say Na Dem Dey Control Hormuz

By: Yusuf Abuh Iran military don reject US Presido Donald Trump claim, wey say na America dey control Strait of Hormuz, dat Trump mouth dey smell, say na Iran dey control di waterway. Iran military tuk, tuk, Ebrahim Zolfaghari, say if na tru say na US dey control di Strait of Hormuz, why e be say no commercial ship or tanker fit pass through di strait without permission and supervision […]

todayAugust 14, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds