OBODO NAIJA

CP Fatai Warn Lagos Police Against Anyhow Behaviour

todayOctober 23, 2026 3

Background
share close

Di Commissioner of Police for Lagos State, CP Tijani Fatai, don warn police officers against brutality, extortion, arrest and detention wey no follow law, as e press mouth say any officer wey do anyhow go see anyhow.

Fatai tok dis one on Thursday, October 22, 2026, for lecture wey e hold for POWA Hall, GRA, Ikeja, where e direct officers to respect pipu rights, obey di law and use social media well, make dia actions no spoil di name of di police.

E also tell officers to fight cultism, warn dem say make dem nor arrest pesin because of anoda pesin matter or arresting for something wey nor make sense.

E say make dem to watch over pipu wey dey police custody and make sure say dem treat dem well.

As di 2027 general elections dey approach, Fatai tell officers make dem no take sides, watch political campaigns and provide enough security to keep peace.

E also tell dem to dey alert to security threats, improve dia work and make pipo trust dem for dia good work.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds