National

Obi Tok Say Tinubu No Fit Handle Nigeria Wahala, Say Make E Dey Go

todayOctober 27, 2026 5

Background
share close

Peter Obi don drag Oga Presido Bola Tinubu say make e comot from seat, as e point finger give am say  im gorment lack di power to handle Nigeria wahala .

Obi, wey dey run for Presidency under di NDC, tok dis one for Abuja on Monday, for di opening of di party National Campaign Council.

Obi say Nigeria need Presido wey go fit mount anywhere for di kontri wey wahala sup.

E use di kidnapping of 600 pipo as example, say gorment no suppose siddon look as dem carry pipo enter bush, but suppose join hand wit security mem dem enter di bush go find and rescue dem.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds