For pesin wey dey experience domestic violence, reporting di abuse fit be one of di most difficult decisions to make, but wetin go happun after that pesin finally loud am? Shey help go come?, shey di abuse go stop?, shey di victim go get peace of mind and soul? or di struggle go continue even after di victim loud am?
Domestic violence don pass make dem dey beat pesin like goat, e fit involve sexual abuse, threats, emotional blackmail, intimidation and to dey control partner money or movement. Some victims dey endure dis kain thing for months or years without reporting them, while odas dey find help but dem fit meet something wey go block dem to japa from di palava.
Fear na one thing wey go make victims close mouth because dem feel say if dem report, that one fit make dia partner vex.
And for oda pipo, na because dem dey rest dia body on di pesin wey dey abuse dem and fear of family pressure and wetin pipo go tok fit also make di victim to close mouth on top di mata.
But if we just focus on why victims fail to report abuse, we no go get to di koko of di mata wey be say, Wetin go happen if dem report?Â