obodo oyinbo

Presido Trump Gree To Give Sick Pipu Medicine For Iran

todayOctober 29, 2026 4

Background
share close

US Presido Donald Trump tok on Wednesday, October 28, say e gree make im Vice Presido, JD Vance, contact Iran to help dem get drugs and oda hospital things for sick people as di war don reach eight months.

Presido Trump follow tori pipo tok for Washington say na Vance beg am to meet Iran, and e gree make am do am to hellep pipu wey dey sick.

Dis one happen as Vance send letter to Iran top security man, Mohsen Rezaei, to see if dem fit tok peace and end di war.

But Trump deny say e send Vance to start peace tok, as di 2 both of dem still dey find way to end di war and settle di fight over Strait of Hormuz.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds