Entertainment

Nollywood Cry As Pete Edochie Go Meet Baba God

todayNovember 25, 2026 4

Background
share close
 Popular Nigerian movie legend and before-before radio broadcaster, Chief Pete Edochie, don go meet Baba God at di age of 79 after long battle with prostate cancer.
Inside family statement wey im pikin, Leo Pete Edochie, drop on Wednesday, November 25, 2026, di family konfamate say di big Nollywood papa kpai around 12:30am inside Enugu.
Di statement show say Chief Pete Edochie come from Akamnato, Ifite Nteje for Anambra State, and e leave behind im lovely wife, Barrister Josephine Edochie, im children, and plenty family people.
Before everybody sabi am for TV and home video, Edochie start work as radio broadcaster way back in 1967, where im deep voice make everybody love am.
Later-later, e enter acting full-time and blow well-well across Nigeria and outside di country after e act as Okonkwo inside di 1987 TV show of Chinua Achebe book, Things Fall Apart.
For plenty years inside Nollywood, e act inside hundreds of movies as strong village chief, king, and wise papa wey dey always drop heavy proverbs.
Because of all di good work wey e do for radio and movie industry, Nigerian government even give am national honour wey dem dey call Member of the Order of the Niger, MON.
Di Edochie family say dem go announce im burial arrangement later, as dem beg everybody make dem pray for im soul and stand with di family during dis sad time.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

Similar posts

Entertainment

Mohbad Family Sti Dey Fight for DNA of Hin Pikin

Di family of late Nigerian singer, Ilerioluwa Aloba, wey everybody know as Mohbad, don demand make dem reveal di name of di US laboratory wey dem wan send di sample go for di DNA test to clear who be di real papa of hin pikin, Liam. Mohbad family still call […]

todayOctober 30, 2026 15


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds