obodo oyinbo

Israeli Airstrike Kpai Senior Hamas Security Boss and E Family

todayNovember 25, 2026 7

Background
share close

Israeli military don kpai senior official, Mohammad Abuelouf, im wife and two children for airstrike wey hit dia apartment for Beach refugee camp, western Gaza City, early Wednesday, November 25, 2026.

Dis na di second Israeli attack wey don kpai senior Hamas security officials within 24 hours, as medics and Hamas-run interior ministry tok say another person kpai for separate airstrike for northern Gaza City later dat morning.

Israel military say dem target several military operatives, while di attack happen despite ceasefire wey start for October 2025.

Palestinian and Israeli figures show say at least 1,600 Palestinians and five Israeli soldiers don kpai since di ceasefire begin.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds