By: Esther Ayoola
Former Attorney General Abubakar Malami on Monday for Abuja don accuse Economic and Financial Crimes Commission say dem dey use political intimidation afta dem raid im house.
EFCC operatives say dem act based on court order wey grant interim forfeiture, and na why dem go mark di property.
For one viral video wey surface same Monday, Malami question di officers and ask dem to show di legal paper wey allow di operation.
Im say di raid nor necessary and e be like way to pressure am politically, Meanwhile EFCC never publicly respond to di allegation.