Di Court of Appeal for Abuja don stop di judgement wey say make INEC cancel African Democratic Congress (ADC) and four other political parties.
Di three-judge panel wey Justice A. B. Mohammed lead vex well-well for Justice Peter Lifu of di Federal High Court, say dem nor understand why im go suspend di case.
Di appellate court say, wetin Justice Lifu do na pure ‘judicial rascality’ and e show say im na Otondo, as im nor follow di 1999 Constitution.
Dem kon finalize am say any judge wey dey behave like tdat, na yeye wey dey smell, and dat im nor suppose be judge.