By: Rilwan Agbomeji
For AFCON 2025 marras, Super Eagles don turn focus go di third-place match against Egypt afta dem lose 4–2 on penalties to host Morocco for semi-final wey happen Wednesday night.
Na for Casablanca dem land on Thursday afternoon, as Naija prepare to face di Pharaohs of Egypt for bronze medal clash.
As dem reach, team schedule recovery training for 6:30pm to cool body and reset mind afta dem lose to Morocco.
Dem talk say di training go open for media, as Nigerians dey wait sharp-sharp to see how Super Eagles go respond for di AFCON 2025 third-place showdown against Egypt.