By: Ayobami Dada
Senate Presido, Godswill Akpabio don petition Department of State Services, DSS, on top one statement wey dem dey circulate for Facebook and other social media platforms, wey allegedly dey attack pipu from Northern Nigeria.
Na di Special Assistant on Media to di senate presido, Jackson Udom, carry di petition for hand giv tori pipu for Abuja on Wednesday.
Akpabio Chief of Staff, Chinedu Akubueze, file di petition on behalf of di Senate Presido, ask DSS to say make dem touchlight di statement wey some pipu wrongly attribute to Akpabio.
Di statement, carry Akpabio picture and official position, allegedly quote am tok say: “Northerners, una go suffer pass if una allow Tinubu lose di election.”