Senate Presido, Godswill Akpabio, don threaten legal action against contractor wey renovate National Assembly complex because microphone dem for Senate and House of Representatives chambers no gree work well.
Akpabio tok dis one during Wednesday plenary after plenty senators struggle to use microphone as dem dey contribute for debate.
E show say di matter dey vex am well well, as e talk say di constant microphone problem don become disgrace for di National Assembly and Nigeria.
Akpabio still remember say di same thing shame am one day before, when e attend di opening ceremony of National Assembly Week for House of Representatives.