OBODO NAIJA

Amaechi Promise To Turn Nigeria Around in Four Years if E Win 2027 Election

todayMay 14, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Former Minister of Transportation and presidential aspirant of African Democratic Congress, Rotimi Amaechi, don promise say e go transform Nigeria within four years if Nigerians elect am for 2027.

Amaechi make di pledge on Thursday after e submit im nomination forms for ADC headquarters for Abuja, where e also blame President Bola Ahmed Tinubu administration for di worsening economic hardship across di country.

Di former Rivers governor tok say di 2027 election suppose focus on competence, experience and performance, instead of ethnic or regional sentiments.

E urge Nigerians to judge all candidates based on dia records and leadership track history as political preparations for di next general election gather pace.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds