By: Rilwan Agbomeji
Former PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, don send message of sympathy to British-Nigerian boxer Anthony Joshua afta road accident happen for Makun, Ogun State, on Monday.
Atiku talk dis one through im official X handle, say e pain am well well and e dey pray make Joshua recover sharp sharp.
According to am, Anthony Joshua still be symbol of strength and resilience, and e sure say e go overcome di situation.
Atiku also condoled with families of di two people wey die for di accident, pray make God give dem comfort and rest di souls of di dead.