National

APC Release 2027 Election timetable, Presidential Ticket For ₦100m, and Govo ₦50m

todayApril 21, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Say like dis All progressives Congrees APC don release dia timetable and schedule of activities for di 2027 general elections.

Dis na according to statement wey di party National Publicity Secretary, Felix Morka tuk  wey im joinbodi sign with National Organising Secretary, Sulaiman Argungu on Monday for Abuja.

Part of di schedule na how dem go run screening, appeal process and party primary elections for different positions, to show how candidates go emerge.

Di statement also tuk say presidential aspirants go pay ₦100 million for expression of interest and nomination form, while governorship aspirants go pay ₦50 million.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app