By Esther Daniel
Di Court of Appeal for Abuja don uphold di guidelines wey di Independent National Electoral Commission (INEC) put in place for di conduct of di 2027 general election.
For joinbodi judgment wey di court deliver on Thursday, di Appeal Court cancel and set aside di earlier judgment wey Federal High Court give on May 20, wey bin nullify di guidelines.
Justice Adebukola Banjoko, wey read di lead judgment, tok say di Youth Party (YP) no get di legal right (locus standi) to file di case against INEC.
According to di judge, di party no fit show how di INEC guidelines affect dem or dia members, especially as e concern dia primary election and di nomination of candidates for di 2027 general election.