ABUJA

17 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Peter Obi Call Make Naija join hands Fight Hunger

By: Damilola Adekunle Peter Obi don call on Naija leaders and citizens to join hand together rescue di country from poverty, hunger and insecurity ahead of di 2027 presidential election. Obi make di call on Monday for Abuja, where e attend di commissioning of Oyo State Gofnor Seyi Makinde 2027 presidential campaign office. Di former Anambra gofnor say Makinde qualify to contest for presido, adding say whoever Naija choose through […]

todaySeptember 7, 2026 9

OBODO NAIJA

ATSSSAN Don Hold Strike Wey Dem Plan Against Air Peace

By: Mariam Ajayi ATSSSAN don suspend di strike wey dem plan against Air Peace, after dem meet with Police IG Olatunji Disu, , for Abuja. Di union say police don ask both sides to maintain peace while investigation into di August 11 picketing continues. ATSSSAN say dem use di meeting explain dia own side of wetin happen during di incident. Di suspension mean passengers no go face di planned strike […]

todaySeptember 4, 2026 8

OBODO NAIJA

IPMAN Say Refineries Revival Go Reduce Fuel Price

By: Mariam Ajayi Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, IPMAN, don talk say bringing Port Harcourt, Warri and Kaduna refineries back to work fit help reduce fuel prices for Nigeria. IPMAN toktok pesin, Chinedu Ukadike, tok dis one during one interview with tok tok channel as debate over fuel subsidy return dey continue. E say di best way to bring down fuel price, wey dey between N1,230 and N1,299 per […]

todayAugust 26, 2026 10

OBODO NAIJA

Primate Ayodele Don Predict Say Tinubu Fit Move Nigeria Capital Go Lagos If E Win for 2027

By: Mariam Ajayi Primate Elijah Ayodele, Popular cleric don predict say Oga Presido Bola Tinubu fit move capital of Naija from Abuja go Lagos if e win di 2027 presidential election.   Di cleric make di prediction for one video for X as Tinubu dey prepare to get anoda term for office.   Ayodele say if Tinubu win again, Lagos architecture go change and di capital fit move to Epe, […]

todayAugust 21, 2026 11

OBODO NAIJA

Oyedele Blasts Nigerians Wey Abuse World Bank Over Nigeria Loan

By: Mariam Ajayi Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy, Taiwo Oyedele, don fault Nigerians wey attack di World Bank for social media over loans to Nigeria, saying dia actions show say dem no understand how di lending system dey work.   Oyedele speak on Wednesday for Abuja during media briefing on di Federal Government economic reform scorecard, where he explain say some Nigerians go World Bank social […]

todayAugust 20, 2026 14

National

Wike Ban Cars For Abuja Green Areas

By: Mariam Ajayi FCT Minister Nyesom Wike don order immediate ban on cars and other unauthorised business for green area, park and garden across Abuja. Wike also order di touchlighting into civil servant wey allegedly dey approve conversion of recreational and protected area into car dealership. Di FCT Administration announce di directive on Wednesday, saying di move dey aimed at enforcing Abuja Master Plan and stopping illegal development. Di decision […]

todayAugust 19, 2026 16

Business

NUPENG Beg Tinubu To Stop Temporary Work For Oil Industry

By: Kofoworola Olayinka NUPENG President Salimon Oladiti don beg President Bola Tinubu to stop temporary work arrangements for oil workers. Oladiti make di request when NUPENG leaders visit Tinubu for Presidential Villa, Abuja. Tinubu say subsidy removal don help government pay salaries and fund major road projects across di country. He thank NUPENG for supporting government, saying di union play important role for Nigeria economy.

todayAugust 14, 2026 16

OBODO NAIJA

Federal High Court Sentence Three Kidnap Suspects To Life Imprisonment Inside Abuja

By : Jolayemi Olajide Justice Salim Ibrahim inside Abuja Federal High Court sentence three suspects on Thursday to life imprisonment for dia link to di abduction of pupils and teachers for Oyo State Oriire Local Government Area, as di judge order make di sentence start count from di date dem arrest dem. Di defense lawyer beg di court for leniency before di sentencing, happening because di convicts plead guilty and […]

todayJuly 23, 2026 15

OBODO NAIJA

Falana Drag FG To Court Based On Dia House Sharing Format Judges

By: Esther Daniel Human rights lawyer, Femi Falana, don threaten to drag di Federal Government go court over di luxury houses wey dem hand over to judges for Katampe area of Abuja. Inside statement, e explain di  gesture as see finish and e no follow any law because other public servants no benefit from am. Falana talk dis after e watch di handover ceremony for television, saying di action dey […]

todayJuly 17, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds