By: Rilwan Agbomeji
Di Lagos State Police Command don begin touchlight marras afta one viral video burst online, show how area boys dey manhandle one uniformed police officer over allegation say im go thief.
Di clip, wey circulate on Wednesday, capture di officer as blood dey pour from im mouth as angry area pipo surround am like say dem get am for mind before.
Shege promax just dey whaooo whaooo for di man face and im dey beg for im life, still wear im uniform, while dozens of area pipo raise dia phones dey record di whole drama.
Even as voices for background dey shout say na thief im be, di exact wetin im allegedly steal still no clear as di time wey dem file di report.