By:Alice Iduh
Troops of Operation HADIN KAI don rescue 12 kidnapped people 7 women and 5 pikin wey Boko Haram carry when dem dey travel for Gwoza–Limankara Road on November 14.
Army yarn say na for Mandara Mountains, Borno State, dem rescue dem on Sunday after dem run coordinated attack under Operation Desert Sanity IV and Diligent Search.
Di soldiers, 26 Task Force Brigade with hunters, vigilantes, and Hybrid Forces, carry out pre-dawn raid, make Boko Haram scatter and leave di captives, wey fear gunshots hide for bush.
Troops sweep the area, find all di victims around 8:45 a.m., and di Army hail di mission as “courage and compassion” on full display.