Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Say like dis, NASA dey celebrate as dem successfully carry four astronauts go round Moon and bring dem back to Earth safely on Friday, and dis na di first lunar flyby wey happen for more than 50 years.
NASA public affairs official, Rob Navias na im dey narrate their return for di agency live broadcast.
Di spacecraft carry four astronauts, three Americans and one Canadian.
As dem dey return to Earth, di spacecraft reach speed wey pass 30 times speed of sound, and face serious heat wey almost reach half as hot as surface of di Sun.
According to Mission commander, Reid Wiseman, e konfamate say im, Christina Koch, Victor Glover and Jeremy Hansen dey stable and okay.
And by late Friday, helicopter come carry dem go recovery ship for Pacific Ocean near San Diego, and all of dem fit waka by themselves without help.
NASA administrator, Jared Isaacman call di journey perfect mission, say dem don return to business of sending astronauts go Moon again, and dis one na just di beginning.
Written by: Ridwan Agbomeji
america artemis ii moon nasa space
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026