By: Kofoworola Olayinka
Gabon football don enter serious wahala after di country crash out of AFCON group stage following three straight defeats, with Ivory Coast giving dem di final blow.
Gabon Presido Brice Clotaire Oligui Nguema describe di poor performance as a blow to di country’s national identity. Gorment later sack di coaching crew, suspend di national team and sideline veterans Pierre-Emerick Aubameyang and Bruno Ecuele Manga.
Di decision spark serious anger among Gabon supporters, as many fans question why gorment go punish some of di team’s biggest names.
Aubameyang himself say di problems for Gabon football dey deeper than one person, as di former Borussia Dortmund and Arsenal striker prepare for wetin fit be im final European challenge with Deportivo La Coruna, wey don return to La Liga.