News-auth

697 Results / Page 55 of 78

Background

Sports

EPL: Man U Appoint Fletcher As New Coachie After Amorim Sack

By: Esther Ayoola Unto update from Old Trafford, say Manchester United don appoint  U18 coachie,  Darren Fletcher as replacement of Amorim, to take charge di senior team until further notice, to steady things for club. According reports, Amorim meet director of football Jason Wilcox and CEO Omar Berrada early mor mor on Monday, wia dem serve breakfast say dem nor want am again. Nor be small tin dis dey cause […]

todayJanuary 5, 2026 9 4

National

SEMA: Yobe Boat Tumbo Kill 29

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Yobe, boat get accident kill 29 pipo, and dem still dey find about 10 wey lost for water. Secretary of di State Emergency Management Agency (SEMA), Mohammed Goje tell tori pipo on Monday dat, rescue work still dey go on, as dem dey try find di remaining people. According to reports say na overloading ni cause di problem, but dem […]

todayJanuary 5, 2026 14

National

Makinde Shake Oyo Cabinet, Sack SSG Adeyemo

By: Esther Ayoola Oyo State Govo Seyi Makinde don announce cabinet reshuffle, on Monday, say im dey observe some kpiance doings. For di move, e sack Secretary to di State Government, Prof Olanike Adeyemo, with immediate effect, According to statement wey im media aide Sulaimon Olanrewaju release for Ibadan, Governor Makinde appoint Prof Musibau Babatunde as di new Secretary to di State Government. E still move Barrister Temilolu Ashamu from […]

todayJanuary 5, 2026 13

obodo oyinbo

Russia Send Bomb Scarra Kyiv, Kpai Two Pipo

By: Esther Ayoola Say nor be small tin Russia do with missile and drone for Ukraine early Mor mor on Monday, kpai, kpai two pipo for Kyiv area and wunjor plenty others. According to local oga dem, say, Air raid sirens dey shout across di country just afta midnight. Ukraine military even try air defence for different areas, ni soften di impact. For Kyiv, one private hospital catch fire afta […]

todayJanuary 5, 2026 9 4

Sports

AFCON 25: Naija Super Eagles, Egypt Do Jim Jim Di Body For AFCON Round 16

By: Esther Ayoola Africa Cup of Nations Morocco 2025 don dey heat up beta style, say four teams don secure quarter-final spots while Round of 16 still dey go on. Senegal enter first afta dem knack Sudan on Saturday, keep dia unbeaten streak for di tournament alive. Later dat same day, Mali follow join, shock Tunisia for penalties even though dem dey play with 10 men. Now Morocco and Cameroon […]

todayJanuary 5, 2026 8 2

Lagos

15-Year-Old Boy Do Give Away For Mothers Inside Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Area gather on Sunday for Lagos Island say one 15-year-old, Onate Oton-Efebo, do beta give away for mothers inside Maternity Hospital. Di Secondary student touchlight tori pipo frequency say, na heart of love for community and for mothers, ni make am run di show. According to Onate, di waka sef dey possible because of beta support wey im get from im mama and papa. Say, dis na […]

todayJanuary 5, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu Leak Sand For Beta Joinbodi Development For Lagos

By: Esther Ayoola Baba govo, Babajide Sanwo-Olu, don clear clear mata wey concern Lagos for 2026 say make Lagos residents nor worry demselves too much dat, 2026 go sengemege, say goment dey plan big projects for transport, agriculture, health, energy, environment and infrastructure. E tuk dis one on Sunday for di 26th Lagos State Annual Thanksgiving Service wey shelle for Tafawa Balewa Square, Lagos Island. Baba Sanwo Olu, say im […]

todayJanuary 5, 2026 7 2

National

Kebbi Goment Open Town Schools Again After Bandit Wahala

By: Esther Ayoola Kebbi State goment don approve make some primary and secondary schools for big towns and cities resume immediately afta wetin jaguda boys use dia eyes see last year. U sabi say, dem bin close schools before, afta bandits attack Gorment Girls’ Comprehensive Secondary School for Maga town for November, wia dem kidnap 25 schoolgirls and kill one school guard. Commissioner for Basic and Secondary Education, Dr. Halimatu […]

todayJanuary 5, 2026 5 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app