News-edi 1

1483 Results / Page 109 of 165

Background

National

Dangote Vow Say Fuel No Go Scarce Dis Ember Months

Aliko Dangote, President of Dangote Industries Limited, don assure Nigerians say dem go get enough petrol (PMS) supply during di festive Ember months. Dangote yarn dis on Sunday as e announce say Dangote Petroleum Refinery go expand from 650,000 barrels per day to 1.4 million bpd. E talk say despite di recent global oil price spike, petrol price no go rise during di season. Dangote also yarn say di refinery […]

todayOctober 27, 2025 27

Lagos

Midnight Demolition Tear Oworonshoki Lagos

Residents of Ojulari, Oworonshoki, Lagos, report say demolition people return late Saturday night to pull down houses for dia community, and dem still dey continue di work reach Sunday morning despite protests and local wahala. Eyewitness yan say two bulldozers dey for di site, while over 50 police officers dey fire teargas for people all through di night. Olarenwaju Segun, one resident, talk say, “We no sleep at all because […]

todayOctober 27, 2025 28

Lagos

Lagos Don Ban Cart Pushers Wey Dey Collect Waste

Di Lagos State Goment don put ban for all di cart pushers wey dey collect waste for di state, na wetin Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab yarn. Wahab talk say di state don sign agreement with one company wey go dey turn about 4,000 tons of Lagos daily waste into compost fertilizer, wey go help create wealth for di people. He talk say Lagos don replace di […]

todayOctober 27, 2025 12

International

Australia Accuse Microsoft Say Dia AI Offer No Pure

Australia competition watchdog don accuse Microsoft say dem mislead people make dem pay for dia AI assistant, Copilot. Di authority talk say dem don file case for Federal Court against Microsoft Australia and dia parent company, Microsoft Corp. Dem claim Microsoft talk “false or misleading” things to about 2.7 million Australians wey dey pay by auto-renew for Microsoft 365 plans wey get online Office services. Microsoft tell people say dem […]

todayOctober 27, 2025 26

Entertainment

Regina Daniels Don Show Off New House As Marriage Gbege Still Dey

Nollywood actress Regina Daniels don show off di new mansion wey she just buy, as tori still dey fly around say her marriage with Senator Ned Nwoko get small wahala. Di actress drop di announcement for her Instagram page where she share fine-fine photos of di big house wey she call her own. For her caption, Regina write say, “For my house, I be Queen! I need roof over my […]

todayOctober 27, 2025 21

Sports

Finidi Happy Say E Don Break Nigeria CAF Bad Luck

Rivers United coach, Finidi George, don hail di team after dem qualify reach di group stage of di CAF Champions League for di first time for di club history, ending Nigeria six-year drought for di competition. Di 2022 NPFL champions make history for Godswill Akpabio Stadium for Uyo on Saturday as dem beat Black Bulls of Mozambique 3–1, secure dia spot for di 2025/26 CAF Champions League group stage. Rivers […]

todayOctober 27, 2025 16

Sports

“Mbappe, Bellingham Run Show As Madrid Win El Clasico.”

Jude Bellingham and Kylian Mbappe shine as Real Madrid knack Barcelona 2–1 for one hot El Clasico clash wey happen for Santiago Bernabeu on Sunday. Di win carry Madrid five points clear for top of La Liga table and end Barca’s run of wins from last season. Mbappe first open scoring with one fine finish after Bellingham set am up, even though e later miss penalty. Fermin Lopez equalise for […]

todayOctober 27, 2025 20

International

Ghana Police Free 57 Nigerians From Cybercrime, Trafficking For Accra

Police for Ghana don rescue 57 Nigerians wey dem traffick enter di country come force dem do cybercrime waka. Authorities confirm di mata on Thursday, October 23. Di victims, all between 18 and 26 years, bin dey trapped inside one house for Accra suburb before police raid am on Wednesday. According to di Criminal Investigations Department (CID), di Nigerians bin dey run online romance scam after traffickers deceive dem with […]

todayOctober 24, 2025 24

International

Women Drag Aussie Army For Court Over Sexual Abuse Wahala

Women wey dey inside Australia Defence Force don carry di Australian government go court for massive lawsuit, accuse dem of long-time sexual violence, harassment and discrimination. Di class action wey dem file for Federal Court inside Sydney on Friday, cover abuse wey happen between November 2003 and May 2025. Lawyer Josh Aylward from JGA Saddler talk say for many female soldiers, “di biggest fear no be war, na di sexual […]

todayOctober 24, 2025 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app