By : Jolayemi Olajide
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don congratulate all Muslims for Lagos and Nigeria as dem dey celebrate dis year Eid al-Adha
Inside statement wey im Special Adviser on Media and Publicity, Gboyega Akosile, release on Tuesday, de govo tell pipo make dem hold di values of sacrifice, peace, and unity strong-strong.
Sanwo-Olu say di festival dey remind everybody about how faith, patience, and to live with peace inside community take mata.
He add say de celebration show di deep faith wey Prophet Ibrahim get, and e show say heavy reward dey always follow person wey get patience and strong belief during trying times.